[Intro]
Hmmmmm.......
It's innocent lad music Exclusive,
Ouuuu… yeah yeah…
O.G ,Mullar…
Girl dem sugar…
Ouuuu na…
I do this song for my bestie…
But I want more…
[Verse 1]
Memunatu… girl you light up my day ooo
From we start talk, I no fit look away ooo
Na your smile dey make my heart dey play ooo
I bin call you bestie… but I want you bae ooo
Every night I dey think about you
Everything wey you do, girl e sweet me pass stew
I no go lie, I don fall for you true
If na dream, abeg make I no wake up soon
[Pre-Chorus]
Ouuuu… girl I no go pretend
This feeling no be only for friend
My heart don dey bend
Make we turn story to the end
[Chorus]
Memunatu… I want make we date ooo
Your appearance don capture my feeling ooo
So accept my love, no delay ooo
Girl I really love you, no be play ooo
I hope say you know say I love you
Everything I do girl na for you
From bestie to lover make we move
Baby make we write our own truth
[Verse 2]
Anytime you call me, I dey smile alone
E anytime you call me, I dey smile alone
[Bridge]
If you say yes, I go hold you tight
We go dey shine, day and night
No fear, no doubt, we go take flight
Memunatu, you and me getting it right
[Chorus]
Memunatu… I want make we date ooo
Your appearance don capture my feeling ooo
So accept my love, no delay ooo
Girl I really love you, no be play ooo
I hope say you know say I love you
Everything I do girl na for you
From bestie to lover make we move
Baby make we write our own truth
It's O.G mullar
Girls Dem sugar
[Outro]
Yeah, Memunatu, na you dey my heart
From bestie to lover, we never apart
Baby, say yes, make we start
This love story we go write together