[Intro]
Clear the way … Destiny just walked in … heavens approves dxzzler Father lord …
Holy Ghost, anoint my brain… anoint my biro… anoint my eraser too!
GCE NO BE JOKE!
[Verse 1]
Timetable long like Commercial Avenue traffic
Bio, Chem, Add Maths — who plan this yawa?
Night prep na war, Mosquito na my witness
Coffee na my iv, My brain dey on 5G fitness
Mama say “no shame me”, Papa say “no fail”
My head hot pass desert sun for scale
Al Ol all we get same pressure
If u no sabi am, Na God go doam
[Chorus]
GCE no be joke oh! Sleep small, you go broke oh!
A1 by fire, B2 by power!
No F9 near my tower!
Holy Ghost na my teacher! E mark my script before I reach am!
Village people plan me fail! But my destiny get strong nail!
[Verse 2]
Midnight glow through study night, I push and I strive
Dreams in the margins, caffeine and prayers alive
From the kenyan mornings to the campus under lights
I lift up my head, I’m aiming for the skies
[Verse 3]
Spirit of blank page, collect fire!
Demon wey dey eat answer die by wire
Spirit of distinction locate my cenrer
[Chorus]
GCE no be joke oh! Sleep small, you go broke oh!
A1 by fire, B2 by power!
No F9 near my tower!
Holy Ghost na my teacher! E mark my script before I reach am!
Village people plan me fail! But my destiny get strong nail!
[Bridge]
Fire in the margins, courage in the line
One more page, one more try, I’ll be fine
[Outro]
Destiny dey walk with me, I dey walk with fate
No retreat, no surrender, I celebrate the rate
GCE no be joke, victory set in sight
We finish strong, we rise by dawn’s light