It's innocent lad music Exclusive,[Intro]
O G mullar yeah yeah ooooo,
I do this song for my brother man jimmtus
Yeah yeah, we outside, vibes on vibes
[Verse 1]
Back then we dey waka na street, no shoe
Now small small, God dey bless all we do
From zero we start, now we dey push through
Jimmtus my bro, I dey para for you
We don see yawa, we don see stress
But you still stand gidigba, no rest
Everyday grind, you dey chase your bread
Now na favor dey follow your head
[Pre-Chorus]
If na money, you go get am plenty
If na grace, e go full your belly
No shaking, my bro, steady steady
Na your time now, you don ready
[Chorus]
Happy birthday, brother man
JimmtuS, you sabi, you understand
Through the pain, through the gbege
We still dey laugh, we still dey okay
Happy birthday, my gee
Na you dey always dey for me
Anywhere belle face or show
You go always be my bro
[Verse 2]
It's innocent lad music Exclusive,
See my bro fresh, drip too mad
Even when life try make am sad
You no fold, you no dull yourself
You just dey move, you dey build yourself
Dem no know all the tins we don pass
All the wars we fight, we still stand brass
[Bridge]
We dey navigate every day, you and me
Brotherhood tight, kpa-kpa, no le
From Lagos to Salone, na unity
We dey ride together, forever we dey
[Chorus]
Happy birthday, brother man
JimmtuS, you sabi, you understand
Through the pain, through the gbege
We still dey laugh, we still dey okay
Happy birthday, my gee
Na you dey always dey for me
Anywhere belle face or show
You go always be my bro
[Outro]
Na so we dey; vibes on vibes, brotherhood forever, aye
Belonging TUS brotherhood